As small as Lagos is…

For my country where police na the thieves,
Na who dem go kon catch?
For my country where Godfathers be the yahoo boys,
Na how this irony take match?

Our leaders don corrupt
And we know say egg wei don spoil no fit hatch.
Dem say Wetin old man go siddon see,
If pikin climb mountain e no go see
But for my county,
Wetin children don see ba,
The old men wei climb Aso Rock no dey see am.

Na this thing make us say wee don waka tire
For this journey to continue, make we find moto,
Even if na hire
We carry water say we go quench the fire,
But
Na for Lekki dem kill us.

We were wrong for being right
We died because we all wanted to live..

Tochi

Click Next To Continue Reading This Post

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *


About us

Everything you’ll find in our literature are products of our thoughts, experiences and challenges. Search for a theme that interests you, read and tell us what you think about it.


CONTACT US

CALL US ANYTIME



Latest posts

May 16, 2023
February 12, 2023
February 12, 2023