Related Articles
One Day…
One day, we sef go make am.
We go build bridge after we build dam.
Abi rain don dey chose where to fall?
Abi everybody wan be like Trump build wall?
Eye wey see no dey hungry at all.
Eye wey sleep go gather poverty for im hall.
You dey lie down when we dey go farm.
If hunger call na your belle go hear am.
“One day” na meat for soup pot;
If you don tey dey take your shot.
This grind na bank wey get interest,
Just dey press am dey go like say na breast.
Younglan Louis
Click Next To Continue Reading This Post