When We Are No More

Dis wan no be word of play
As d sun dey shine, make u sef make hay
Na today don born, tomorrow still get belle
Life no be 100 metres race, na relay

One day one day, I go waka go heaven,
But e get dis koko mata wey I mus yarn:
No be evribodi wey call you G be ur padi,
Street na by grace no be by hu sabi,
No make mistake snitch on anibodi,
Nobodi holi pass, u self get ur stain,
Dey ur lane make u no go dey compete,
As I talk b4, lyf na relay, na turn by turn,
Make u try dey ignore “dem say dem say,”
Na only one man fit do am, abeg try dey pray,
You go c say God go make ur huzzle pay.
Notin follow u come dis earth
Notin go follow u go back 2,
But ur name go remain if u do gud.

Dis wan no be word of play
As d sun dey shine, make u sef make hay
Na today don born, tomorrow still get belle
Life no be 100 metres race, na relay

Wildkhard [TA]

Click Next To Continue Reading This Post

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *


About us

Everything you’ll find in our literature are products of our thoughts, experiences and challenges. Search for a theme that interests you, read and tell us what you think about it.


CONTACT US

CALL US ANYTIME



Latest posts

May 16, 2023
February 12, 2023
February 12, 2023